fbpx
April 25, 2024

Sokoto Governor present N198.5b budget to State Assembly

0

Sokoto State Governor, Hon. Aminu Waziri Tambuwal don present budget of N198.5 billion to di State House of Assembly for di year 2023.

Tanbuwal bin beg di Speaker and di State lawmakers to quickly approve di 2023 budget for di betterment of di entire pipol of Sokoto State.

U FIT ALSO READ Di fall of Naira don add N9tn to Nigeria foreign debt 

According to tori “Sokoto bin dey among di few States for nigeria way bin fully adopt di principle of realistic and all-inclusive budget.

Di governor tok say di state don alreadi sign up to di Open Government partnership (OGP) in fact, dem bin abide to all principles long bifore government endorse am.

Hin tok say di pipol of di State, in previous years, bin dey aware of wetin hin dey present give di house today.

Di 2022 Budget way bin tag “Budget of consolidation and finishing strong’”, symbolize di change of guard and realistic approach to fiscal policy to hin administration.

According to him, di total budget size for 2022 as passed bi di House was ₦188,429,495,847.63, including some capital expenditure and other misselenious.

To read di full tori CLICKHERE

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *