fbpx
April 18, 2024

Three pipo die for Lagos-Ibadan Expressway lone accident

0
Lagos-Ibadan-Expressway-accident.

Three pipo kpai and three others getn serious wound for lone road accident on Lagos-Ibadan Expressway.

Di Sector Commander of di FRSC for Ogun, Mr Ahmed Umar, confirmed this to newsmen on Monday for Abeokuta.

Umar explain say di accident happen for di early hours of Monday and e involve Toyota Sienna with registration number DKP 60 LG.

YOU GO LIKE READ: Use of Artificial intelligence in Education

He add say e happen just before first AP turning point after Danco filling station for di expressway.

Di FRSC boss mention say six pipo, wey include four males and two females bin dey inside vehicle.

“A total of three people were injured, two male adult and one female adult and unfortunately three persons lost their lives in the accident,” Na wetin hin talk be that.

This tori dey inside Punch, click here go read the remaining tori…READ MORE

For more news: CBN:Obasanjo image deserve to dey inside di new Naira note – Reno Omokri

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *