fbpx
March 29, 2024

US-based Naija researcher don receive grant, award

0
Ekiomoado-Esekhaigbe.

One Naija Doctor of Pharmacy and researcher wey dey live for United States, Ekiomoado Esekhaigbe, don receive grant from international Foundation and achievement award.

Dr. Esekhaigbe collect di grant from United Kingdom-based Jose Foundation to take support her work for di area of mental health advocacy and well-being, and di achievement award wey she collect, na di University of West Georgia for di United States na hin give her.

YOU GO LIKE READ: Online Marketing Guides for Pharmacists

Di Jose Foundation aim na to tackle di social attitudes wey dey associated with Child Sexual Exploitation, Gender-Based Violence, di assumptions and myths around di effect wey dey part of mental health disorders, and that kain thing na hin dey lead to discrimination, exclusion, and stigma.

Di Emergency Grant for Humanitarian Projects na £30,000 grant award wey dem wan use promote support of projects wey go impact di lives of di pipo wey dey affected by Gender-Based Violence or Child Sexual Exploitation.

Na inside Punch this tori dey, you fit go read more of the tori…READ MORE

For more News: FG return 117 Nigerians From Libya

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *