fbpx
March 29, 2024

Twin sisters, collect first class degree for di same university

0

Identical twins, (Ejimeh) wen bi Taiwo and Kehinde Olude, dey among di sevengraduuate way dem go award for first class degrees at di 8th Convocation ceremony of Glorious Vision University, GVU (formerly known as Samuel Adegboyega University), Ogwa, for Esan West Local Government Area of Edo State.

Di Vice Chancellor of di university, Prof. Adewumi Idowu, announce dis one at di pre-2022 Convocation press conference, wen sele for di institution, yesterday,

U FIT ALSO READ Covenant University don win best private university award

Di vice chancellor tok say di two ejimeh achieve dia first class degree from different departments inside di school. one na Economics she study while di second one study Chemical Sciences.

Hin tok say na di first time way dat kind thing go happun say twins graduate with first class degrees for inside di same same school and for di same academical session.

Since di history of GVU, di school don produce six sets of graduates with a total number of 670 undergraduates, eight postgraduates and nine Honorary Doctoral Certificates.

Bi di grace of God, dis year, dem go produce up to 101 with seven (7) graduating with First Class honours, 33 with Second Class (Upper Division), 46 with Second Class (Lower Division), seven with 3rd Class and four Postgraduates.

Hin tok say dis 2022 graduating class na di set of twins from di Olude family, both of dem graduate with First Class honours.

Taiwo Abigail Olude collect di best graduating student from Economics Department and Kehinde Mary Olude also collect di second best graduating student from Department of Chemical Sciences.

Prof Idowu tok say di institution don try well well in maintaining high academic standards, and dis one don make dem collect recent award as di best private university in di South South region.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *